On the drudgery of study….

Totally unintelligible post alert!

Mehn… I tire for this book marra o…. Oyinbo sef talk say ‘all work and no play go turn persin to jackie’… Na im make me come try yarn some small okpata;  make e no come be like say I dey turn kolo……Shey una grab? No min’ me o.. I just dey try clear my ogor, make small space for correct book fit still dey… Aftera.. I no thief persin certificate o.. Dem no dey die put jare!

Ehen….. But why to dey read book come hard pass to dey read blog sef? Abi no be the same English? Or una dey putt jaaaaz for hand take dey write? If na jaaaaaz make una bring small make i take write exam o… Make my Prof just dey believe all the odus wey I dey float give am!

Mscheeeew… Make i go try read again sha… Make my mama moni no loss… U know every na… Cos if the moni looooss,  na full community go feel the yawa o!!!!

Anyhoos.. I don waka o… Shee u later!